May 18, 2024
18347286 img20240503wa0043 jpeg8763c8ce319a0f684119350c7da1a9f5

One Chemistry graduate from Nnamdi Azikiwe University, Awka, Anambra State, Juliet Chidiebube Uka, don score 324 for di just-concluded 2024 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Uka bin be di best student for Chemistry department for UNIZIK for 2021, come graduate with first class.

She talk say she write UTME again dis year to study Medicine as she dey pursue her dream of becoming a medical doctor.

Her result wey dem release show say she score 324 for UTME as she dey try enter di university again.

Her big brother, Obiora Uka, talk say her sister don already set her mind say she must study medicine and surgery by fire by force.

“She don show strong spirit with her outstanding performance. She don dey talk say she wan be doctor, and dis make her write JAMB again dis 2024 and she score 324,” he add.

Obiora talk say di family dey hope say she go fit achieve her lifelong dream of becoming medical doctor.

Meanwhile, pipo for social media still dey share results of candidates wey write di 2024 UTME.

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) talk say 1,402,490 out of 1,842,464 candidates no fit score reach 200 out of 400 marks.

Pipo still dey show results of some UTME candidates wey score 300 and above, like di daughter of one lecturer for Ahmadu Bello University, Zaria for Kaduna State; Toro Shehu, wey score 348 out of 400.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *