May 18, 2024
Wofai Fada in-laws don reject marriage to their son, dem release public statement (Pics)

Nollywood actress and comedian Wofai Fada in-laws don come out tok say dem no gree di marriage wey she get with their son, Taiwo Cole.

Di Cole Family wey dey for Victoria Island, Lagos, na dem issue di statement wey talk say dem no know anything about di marriage between their pikin, Taiwo Olakitan Cole, and Wofai Fada.

Engineer Kunle Cole, na him sign di disclaimer on behalf of di family, and e talk say no bodi – no friends, relatives, or acquaintances – sabi anything about di marriage. Dem talk say dem no give any authorization for di marriage.

Dem advise di public make dem no take serious any tori or papers wey dey circulate about di wedding.

Somebody come spread di tori say di actress dey carry belle.

Una go remember say Wofai Fada bin share fine photos of herself and her lover wey she no show di public im face. She share di photos for her Instagram page.

Di pre-wedding photos show her dey show off her engagement ring while she dey kiss her husband.

From di caption, e be like say di couple go marry dis same 2024 even though dem never announce di official wedding date.

The statement reads:

“Images and videos come to our attention showing our son Taiwo getting married to a Wofai Ewa in a traditional ceremony in Ugep, Cross River State. This serves to notify all acquaintances, family, and friends that the Cole family of Victoria Island Lagos are not aware of any marriage ceremony of our Son Taiwo Olakitan Cole, neither did we grant permission nor support in this regard. As such, person(s) parading themselves as new members of the Cole heritage by virtue of this purported event, are not known nor accepted by the family. All publications and documents being circulated about this are to be disregarded.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *