May 18, 2024
Real Madrid don become La Liga champions as Girona shock Barcelona

Real Madrid don confirm as LaLiga champions for di 2023-2024 season.

Dis one happen afta Girona knack Barcelona 4-2 for di late match.

Carlo Ancelotti’s men bin knack Cadiz 3-0 for house, thanks to goals from Brahim Diaz, Jude Bellingham and Joselu.

With dis result, Real get 87 points afta 34 matches.

Barcelona loss land dem for third place with 73 points, wey be one less than Girona.

Dis na di 36th time wey Los Blancos go carry di league title.

Real go host Bayern Munich for di second leg of dia Champions League semi-final clash, wey di game dey level 2-2.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *