May 20, 2024
"Oyinbo people don start dey rush come Nigeria for medical treatment," Health Minister yan

Federal goment don talk say di kontri healthcare system dey attract foreign patients, including Indians wey dey find medical treatment.

For one interview for Arise TV on Monday, Minister of State for Health, Dr Tunji Alausa, talk say di kontri healthcare no dey crisis again.

E yarn say as dem don improve di healthcare system, Nigeria dey see say medical people wey run go abroad dey return house.

Di Minister talk say Nigeria don turn hotspot for medical tourism, especially for surgical operations, wey dey cheaper pass other countries.

According to am, di plenty plenty aesthetic hospitals wey don reach almost 900 for Nigeria dey also draw patients wey dey find services like plastic surgery.

Today, we get almost 900 aesthetic hospitals for Nigeria. People dey come for plastic surgery,” na so he talk.

He explain say di government dey committed to put public health for front, and dis don bring better changes for di healthcare sector.

We get President wey believe say healthy nation na di main key to tap into our biggest asset, wey be our human capital,” Alausa yan.

He add say government don set aside money and dey work with others to make primary healthcare better and make health insurance cover plenty people.

Di President don tell us to increase di number of people wey get health insurance from about seven million to about 50 million for di next two to three years. Dis na di highest budget wey dem don give di health sector for almost 24 years,” na so he talk am.

REALATED  Federal Government talk say dem go give people free ride for Port Harcourt to Aba Railway from May 1 to May 4

Source: NaijaChoice

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *